As I dey look you for eye,
your pity just dey do me for mind,
but the wahala wey you dey look for,
na the wahala wey you go find.
You dey shine eye well well but
e be like say you no dey see.
My body and blood don hot well well;
what have this love thing do for me?
I dey always do plenty things for man;
I dey cook all kind sweet sweet food.
Of all the man wey I don love,
las las, no one even do me good.
The palava wey love give me too much;
I no just get strength for pain again.
Abeg waka away comot from my front;
If I love you now, wetin I go gain?